Goat and Hyena Knife
Wekunya Cornelius
Wiehan de Jager

Once upon a time, food been no dey, everiwia dry. Di animals com begin eat only grass.

Notin been dey. Only di imbowa plant on top big trees dem been com survive.

1

One day goat see wen Hyena pass wit knife.

Goat ask for di knife so dat she go cut imbowa plant chop.

2

Hyena giv goat di knife. She cut di plant, she eat am until she belleful.

Goat com forget about di knife wey she been even use.

3

Wen Hyena com ask for di knife, Goat no com know wetin to do.

She been no fit remember wia she drop di knife.

4

Goat scatter everiwia de find di knife.

Till today Goat still de find di knife.

5

Hyena tell Goat, "SInce you don loss my kinfe, wey I been de take make money, I go chop you. Den I go com chop ya pikin too."

6

From dat time till now, Hyena no de take eye see goat o, e must chop am.

7

Meanwhile, goat still de waka de find Hyena Knife.

8
You are free to download, copy, translate or adapt this story and use the illustrations as long as you attribute in the following way:
Goat and Hyena Knife
Author - Wekunya Cornelius
Translation - Mimi Werna
Illustration - Wiehan de Jager
Language - Pidgin English (Nigeria)
Level - First paragraphs