Selemeng cats dem
Khothatso Ranoosi
Marleen Visser

Selemeng like cats well, well.

Na so so cats full her house.

1

Selemeng get one black cat.

Dis cat sabi eat plenti meat.

2

Selemeng get one fat cat.

Dis cat sabi eat everitin.

3

Di number 3 cat, run climb tree.

Dis cat been com hang for di tree.

4

Selemeng climb di tree. She and di number 3 cat kuku com hang for dia.

Selemeng mama naim com help dem com down.

5

Selemeng get two lazy cats.

Dem like to lie down for inside sun for di whole day.

6

Selemeng get three cats wey like to dey busy.

Dem de catch rats for inside kitchen for night.

7

Selemeng get one dog. Him name na Lirafi.

Lirafi no get friends. Him dey sad.

8

Selemeng cats no like Lirafi. Dem de always pursue am comot from house.

Lirafi de always run away.

9

Selemeng go always go find Lirafi bring am com back house.

Di cats no too dey happy. Dem no wan see Lirafi again.

10

Na how many cats Selemeng get?

She get eight cats.

11

Na how many dogs Selemeng get?

She get one dog.

Wia Lirafi com dey now?

12

Na how many cats you get for ya house?

How many dogs you get for ya house?

13
You are free to download, copy, translate or adapt this story and use the illustrations as long as you attribute in the following way:
Selemeng cats dem
Author - Khothatso Ranoosi, Marion Drew
Translation - Mimi Werna
Illustration - Marleen Visser, Wiehan de Jager
Language - Pidgin English (Nigeria)
Level - First sentences