

E get one time wey e be say animals been de talk.
Mama Mosquito and Pikin Mosquito dey live for one house.
Mama Mosquito been always de leave Pikin Mosquito for house wen she de go find food.
One day, afta house Mama leave house, Pikin Mosquito been wan go outside.
Wen Mama Mosquito com back later, she see say her pikin don comot.
Mama Mosquito com de worry. Pikin Mosquito been dey outside only am.
But as she dey de wonder so, Pikin Mosquito com com back house.
Pikin Mosquito com dey happy well well.
"Mama, di human beings been happy to see me o. Na so so clap dem been dey clap for me everi time wey I pass dia side.
Fear com catch Mama Mosquito.
"You say pipo been de happy well well as dem see you de clap for you?" she ask her pikin.
"Dem been no happy see you o. Na kill dem been wan kill you so!" Mama explain giv am.
She com warn am talk say, "Human beings no de eva happy see mosquito o."

